Deborah Sokoto 'Blasphemy': Shehu Shagari College of Education shutdown for student death

Video of Deborah Samuel Sokoto Blasphemy killing: "Deborah Samuel blasphemy mob killing shutdown Shehu Shagari College of Education Sokoto"

Wia dis foto come from, UGC

Video of di killing of Deborah Samuel for alleged blasphemy inside Sokoto don provoke condemnation across Nigeria.

"Di mob wey descend on di female student also go on a rampage destroying property including vehicles as well as blocking a major highway."

Na wetin Police tok as dem launch full investigation into wetin happun.

Dis na full tori of how dem kill Deborah inside Shehu Shagari College of Education for alleged blasphemy.

Sokoto state close down di tertiary institution indefinitely afta di student death on Thursday.

Deborah Samuel lost her life on di college campus as kasala burst in di morning.

Now heavy security dey di school and both goment plus di school authority don order students to go house sake of di incident.

One Sokoto based journalist tell BBC Pidgin say wahala start afta one voice note from Deborah drop on a whatsapp group.

"Di voice note wey dem say contain 'blasphamy' word against di holy prophet for Quran don go viral." Di journalist tok.

E no dey clear exactly wetin she tok or share for di voice note.

Di mata don become viral conversation with outrage and reaction across Nigeria.

Wetin police tok on Deborah death?

Sokoto state Police command don begin investigate di 'killing' of Deborah Samuel.

Deborah be 200 level Economics student of Shehu Shagari College of Education.

Police tok-tok pesin for di state, tell BBC Pidgin say although di incident happun, di details still dey sketchy.

ASP Sanusi Abubakar add say na from di investigation dem go really find out wetin really happun.

Tori be say dem mob her to death.

Di mob also go on a rampage destroying property including vehicles as well as blocking a major highway.

Police say two suspects don dey arrested and di tertiary college don dey closed until further notice.

Video of Deborah Samuel Sokoto Blasphemy killing: "Deborah Samuel blasphemy mob killing shutdown Shehu Shagari College of Education Sokoto"

Wia dis foto come from, Sokoto State Commissioner for Information

How Deborah Samuel death happun - Account of tori pesin

Dis na wetin a local based tori pesin wey dey Sokoto for wia e happun say im hear.

"Dis morning around 9am problem start afta one female student of di school allegedly insult di name of dia holy prophet"

"So some student for di campus drag her out from her hostel and start stoning her and some dey beat her wit stick"

"Dem then kill her and set her bodi on fire."

Viral videos on social media dey show footage wey be like di same account of dis Sokoto tori pesin.

However, BBC Pidgin no fit independently verify di content of both di viral videos and voice notes.

Di tori pesin Abubakar Imam add say; "From wetin I hear, di student use dia WhatsApp group to make di comment"

"Dem set up di WhatsApp group for discussing academic activities and oda things, so one student post something on religion on dat group"

"So di female student comment ontop di mata and in di process of commenting and condemning di action of dat student, she then use di 'blasphemous' words.

But di tori pesin no fit repeat or say di exact word wey dem say be di 'blasphemous' words inside di voice note.

Video of Deborah Samuel Sokoto Blasphemy killing: "Deborah Samuel blasphemy mob killing shutdown Shehu Shagari College of Education Sokoto"
Wetin we call dis foto,

Sokoto State Govnor Aminu Tambuwal order di immediate close down of Shehu Shagari College of Education sake of Deborah Yakubu

Sokoto state goment react to Deborah Samuel death

Sokoto State Govnor Aminu Tambuwal don order di immediate shutdown of Shehu Shagari College of Education.

Di govnor on Thursday direct di state Ministry of Higher Education to investigate di immediate and remote cause of Deborah Samuel death.

Oga Tambuwal also ask all relevant security agencies for di state to look into Deborah death and report back to di goment.

Information Commissioner Isah Galadanci condemn di action of di students for statement wey e release on behalf of di state goment.

Armed police and military men don go tanda for di school campus to maintain law and order following di closure.

Video of Deborah Samuel Sokoto Blasphemy killing: "Deborah Samuel blasphemy mob killing shutdown Shehu Shagari College of Education Sokoto"

Wia dis foto come from, Twitter

CAN react

Christian Association of Nigeria Chairman for Sokoto State, wey also confam di incident say e just dey comot of di office of di oga of Nigeria secret police DSS.

And dat wetin dem tell am be say Deborah Samuel bin post something for dia class whatsapp group wey her oda mates claim say e dey blaspheme dia prophet.

Tori be say di whole tin come lead to heated argument .

E say e neva dey clear di nature of content wey di lady post wey dem see am as blasphemy but dat im dey also dey try to find out wetin really happun.

Sultanate react

Di sultanate council don condemn and describe di killing of Deborah Samuel as unfortunate.

Sokoto Sultanate Council ask security for di state to ensure say dem catch all those wet get hand for di death of Deborah

Di council say dem condemn di incident in its totality and call for peace in the state.

Nigeria most senior Islamic religious leader, di Sultan of Sokoto, Sa'ad Abubakar, don condemn di killing of di Christian student and dey beg for calm.

"Di Sultanate Council don learn with surprise di unfortunate happening for di Shehu Shagari College of Education, (SSCOE) Sokoto wey lead to di loss of life of one female student of di institution.

Sokoto state na di seat of di Caliphate - wey mean say na dia di supreme leader of Muslims in Nigeria tanda.

And sharia law dey in practice for di south west Nigerian state.

Video of Deborah Samuel Sokoto Blasphemy killing: "Deborah Samuel blasphemy mob killing shutdown Shehu Shagari College of Education Sokoto"

Wia dis foto come from, SHEHU SHAGARI COLLEGE OF EDUCATION, SOKOTO

Wetin we call dis foto,

Shehu Shagari College of Education na a state government higher education institution wey dey located inside Sokoto town for northwest Nigeria. E dey affiliated to Ahmadu Bello University and Usmanu Danfodiyo University for dia degree programmes.

Blasphemy meaning

Blasphemy na wen person insult or disrespect God, important pesin or object for particular religion or anything wen dem be consider as divine.

For Islam, di mata na wen pesin disrespect or abuse important figures for di religion or any Islamic law.

Di worst na wen pesin tok bad tin about God or prophet Muhammad dat one na death penalty.

While odas like abusing or disrespecting top disciplines or islamic laws get various punishment

According to experts, di blasphemy laws dey different and no be all dey lead to death.

Punishment for blasphemy in Islam

Divided between a Muslim north and Christian south, Nigeria get general nationwide laws against blasphemy wey Customary Courts fit interpret.

Nigeria get specific Islamic laws against blasphemy wey Sharia Courts inside di twelve northern Nigeria states fit interpret.

Di Customary law against blasphemy dey for Section 204 of di Criminal Code of Nigerian law book.

Dat section forbid any act wey publicly insult any religion and put a prison sentence of up to two years as penalty.

Yusuf Sani wey sabi Sharia law say afta Allah, next for Muslims na prophet Muhammad [SAW].

"And anybody wey disrespect am fit get death sentence."

"Even regarding disciples of di prophet dem get levels, for example Abubakar, Umar, Othman and Aliyu wey be caliphs and top figures for di religion;

"Dem no dey abuse or disrespect dem or punishment fit follow pesin." Sani add.

Recent blasphemy-related events in Nigeria

Video of Deborah Samuel Sokoto Blasphemy killing: "Deborah Samuel blasphemy mob killing shutdown Shehu Shagari College of Education Sokoto"

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto,

Mubarak Bala renounce Islam for 2014

Recent blasphemy-related events wey don happun for Nigeria include:

  • April 2022 - Kano court sentence popular atheist to 24 years in jail for blasphemy. Di court find Mubarak Bala guilty of blasphemy against Islam. Mubarak Bala, di 37-year-old president of di Humanist Association of Nigeria, plead guilty to all 18 charges and ask for leniency. Na since 2020 dem don detain am.
  • August 2020 - Kano sharia court sentence Nigeria musician to death for blasphemy of Prophet Mohammed. Upper Sharia court for Kano northwest Nigeria don sentence singer Yahaya Aminu Shariff to death by hanging. Di sharia court find am guilty for saying wetin no good about Prophet Muhammad (SAW).
  • 2009 - local newspaper Daily Trust report say youth for Sara town of Gwaram Local Government Area of Jigawa State, burn police post and wunjure about 12 persons sake of say di group complain say pesin dey share pamphlets wey dey yab di Islamic prophet Mohammad.
  • 2007 - One group of Muslims bin beat one Christiana Oluwatoyin Oluwasesin till she die. Dem bin accuse her say she touch bag wey Quran dey inside. Oluwasesin be Christian and teacher inside Gandu for Gombe state.
  • 2007 - Sharia court for Kano sentence one Sani Kabil to three years for person sake of accuse of blasphemy but appeal court later free di man for 2009 after two years for prison.
  • 2007 - Some jaguda for Tudun Wada in Kano state kill nine pipo and burn churches after dem say some student disrespect prophet Muhammad.
  • 2002 - Nigeria suppose hold Miss World modelling, Muslims for north begin dey riot after one local newspaper bin report say prophet Muhammad go like take wife inside di models if im dey alive. Di report vex dem and dem burn di local tori office for Kaduna. Nigeria later carry di pageant go London after di fight.